$150m allegation, on peter obi

#ToriForTown wit Bigmo Naija: As one group wey dem name nah Tinubu-Shettima Connect bin accuse Obi say im collect $150m donation from Nigerians wey dey obodo oyibo, say as e violate the Electoral Act on campaign funding, we Independent National Electoral Commission (INEC) suppose disqualify am. But as the Presidential candidate of the Labour Party, Peter Obi dey talk inside one meeting wit Nigerians wey dey London, im talk say the allegations dey based on just speculation and say nobodi give am anytin. Becos wetin im need no be wetin dem go give am, but nah wetin the people go give Nigeria, as we need dem to turn around Nigeria. Say dis nah the kain ginjah wey we need to turn around Nigeria. Say every country wey get turn around, nah the people wey dey obodo oyibo (diaspora) help do am. Say even inside the Bible, Joseph wey leave bin later come back to feed im people… 

How you check am? 

#ChookMouth #ToriForTown


Comments

Popular posts from this blog

HISTORY OF (AMUMA) THE LAND OF THE GREAT PROPHET'S

dike nwamii ohafia, a story of the ancestors๐Ÿ’˜